Lisa Hanna: Meet di Jamaican ’presidential candidate’ wey her video dey make pipo tok - BBC News Pidgin
▻https://www.bbc.com/pidgin/world-53875589
Two weeks ago many Nigerians no sabi who Lisa Hanna but dis change afta one video begin circulate for social media wey show di woman as ’Jamaican Presidential Candidate’.
Well we get di real gist behind di woman - and who she really be. But we fit tell you now for free: she no be presidential candidate.
E no dey clear why dem refer to her as di ’Presidential candidate’ for di video posts wey pipo share for dia timeline, but di ’promotional’ video torchlight madam Lisa work for di constituency wey she dey represent as member of Jamaica parliament.